Anda di halaman 1dari 1

BE LIKE JESUS—NO JOIN THE WORLD

Wetin person wey go give this talk go do:


Talk about Jesus example. Help everybody understand wetin e mean make dem no dey part of the world. If
you fit, use example of things wey dem dey do for una area

WHY WE NO SUPPOSE JOIN THE WORLD (5 min.)


Like Jesus Christ, Christians no go join the world [Read John 17:16]
The “world” wey Jesus sey make we no join na the people wey no dey do wetin God talk (it-2 1209-1210)
Na Satan dey control this world (1Jo 5:19)
This world spirit dey make people copy Satan character (Joh 8:44; Eph 2:1-3)
E dey encourage people to do things wey God no like (Ga 5:19-21)
JESUS SHOW US WETIN WE GO DO MAKE WE NO JOIN THE WORLD (12 min.)
Jesus no gree join politics (Joh 6:15; 18:36)
We too no go put hand for politics (lv 52, box)
Jesus no gather property for imself (Mt 8:20)
Make wetin we get reach us, and make we put the kingdom first (Mt 6:31-33; 1Ti 6:8)
Jesus no let the world change the way e dey do things (Joh 14:30)
Make we no love the world or the things wey dey inside (1Jo 2:15, 16)
Jesus use im example show us how we go take reject the things wey fit enter our eye for this world
(w13 8/15 24-26 ˚7-12)
Jesus no let wetin im body want control am (Lu 4:1-4)
Jesus no let wetin im eye see put am for trouble (Lu 4:5-8)
E no show imself (Lu 4:9-12)
Like Jesus, make Bible dey guide wetin you dey think and do (w13 8/15 26-27 ˚13-17)
Use God word fight temptation (2Co 10:3-5; w11 1/15 22-24 ˚5-10)
LIKE JESUS, YOU FIT WIN THE WORLD (8 min.)
People wey no dey join the world, dem dey hate dem well well (Joh 15:18, 19)
Jesus give us mind sey e dey possible to win the world [Read John 16:33] (w03 3/15 4-6)
People wey dey follow Jesus dey win the temptation to dey carry shoulder up
Jesus teach the people wey dey follow am sey make dem no dey carry shoulder, and make dem get the
mind to serve other people (Lu 22:24-27; Joh 13:3-5, 12-15)
Make we no dey struggle to get big name or to dey popular for this world (w12 12/15 6-7 ˚9-12)
Make we no too dey praise people wey don make name for sports, wey dey act film, or other people like
that, like sey we dey worship dem
People wey dey follow Jesus no dey hate other people
Some people dey do things wey dem no know sey e fit cause trouble, fear dey, and hate; all this things no
dey make people for this world get one mind
Even with all this things wey dey happen for the world, better Christians still dey show love for each
other (Joh 13:34, 35; 15:12, 13; 1Jo 3:15)
Jesus even teach Christians sey make dem love their enemy (Mt 5:43-45)
We need to get faith if we no want join this world [Read 1 John 5:3, 4]
We must get faith sey Jesus don dey rule as King and sey e go soon destroy this wicked world
This kind faith go help us continue to dey obey God law and we no go dey think or dey do things like the
people for this world
THIS WICKED WORLD GO SOON END! (5 min.)
Na small time remain, Satan wey dey rule this world no go dey again to deceive people (Joh 16:11; Re 20:1-3)
This world wey Satan dey control and things wey e like no go dey again [Read 1 John 2:17]
E go good if you dey always choose to do wetin Jehovah want everytime
When we enter paradise, life go sweet and we go forget all the pain and the things wey we suffer because we
no join the world (2Co 4:17, 18)
[No comot from wetin this outline talk. Follow the time wey dey all the part. You no need to read or talk about
all the Bible verse. Check Ministry School book, page 52-55, 166-169]

No. 11-NGP 12/16 NA 30 MINUTE TALK BE THIS


˘ 2016 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania

Anda mungkin juga menyukai